Sep 8, 2012

ORDINARY WRAPPER, YOU NO FIT CLIMB...

A pretty lady got stranded, so she arrived Lagos at about 12 midnight. She come begin follow okada people wey still dey work late talk. One okada guy come finally agree to take her home so she can pass the night...

When dem reach the okada guy house, as na only one 6 spring bed dey there, the woman take her wrapper demarcate her side from the okada guy...

As day break finish, dem begin waka comot for house and the okada guy begin help the woman trace her final destination. Wind come blow the woman's scarf over the fence of a house by road side...

Na so the okada guy pack immediately.

Lady: Wetin happen?

Okada Guy: I dey try climb the fence to help you pick your scarf from inside that house...

Lady: Leave that thing abeg, ORDINARY WRAPPER DEY THERE FOR NIGHT WEY YOU NO FIT CLIMB, NA NOW YOU WON CLIMB FENCE? Make we dey go joor!

No comments:

Post a Comment