Sep 2, 2012

SEE!!!

Look make I just warn all of una.

If I hear say u no thank God enh!

243 days out of 365 na beans?

Boko Haram reach ur side?

U dey 4 Dana Crash?

God give u good health, no be so?

God no allow all dose witches and wizards 4 ur village get power over u, I lie?

Naija no good Naija no good u dey use BB, BB wit subscription 4 dat matter, no be true?

If at all u never get money buy Blackberry Porsche, d BB wey u get no dey ping?

Abi u don see where person wey dey comma dey ping?

Oya lie say u no dey 2go untop that Nokia.

Abi na blind man wan change DP?

Even if na torch light phone, u nor dey take am see for night?

ABEGI SHOPE TIE!

BABA GOD THANK YOU.

MORE FUN AT:
Twitter page: @CenBankofJokes
Mobile page: cbjokes.mobi
CBJ BLOG: centralbankofjokes.blogspot.com

No comments:

Post a Comment