Nov 6, 2012

AKPORS DEY FOLLOW INSTRUCTION DIE!!!

Central Bank of Jokes(CBJ)
Akpors' elder brother, Rukewe, travelled to London months ago, leaving behind Akpors, their aged mom & their pet cat, kelly.

Last week Rukewe called from London to know how they're doing...

RUKEWE: Akpors how una dey now, how kelly?

AKPORS: Kelly done die.

RUKEWE (after a pause): Akpors u for use small small reveal dis kin bad news na. U for jus say d cat fall inside well but neighbors de try comot am. Den when I call again, u go say e break neck small but vet doctor dey try revive am. Den when i call again, u go say dem try their best but dem no fit save am. Na so dem dey reveal bad news in a mature way. u hear me?

AKPORS: Yes bros.

RUKEWE: Ok. how mama na?

AKPORS: Bros. mama sef fall inside well o, but neighbors dey try comot am.

(Phone cuts)

Rukewe has been admitted in a private hospital in London after going into coma.

No comments:

Post a Comment