Nov 19, 2012

FUN+

(JOIN THE FUN)

GOD IS WATCHING U IN 3D RELOADED

U dey sleep ontop mat com dey update for ur fb 'water bed things'
#GodIsWatchingUin3D

Ur mama dey sell stock fish, ur papa dey change money, u say ur parent dey into STOCK EXCHANGE.
#GodIsWatchingUin3D

U and ur friends carry bikes follow una sef for road, u say na 'convoy things'
#GodIsWatchingUin3D

U be 18, com dey date 59 years old man, come talk say 'I love my baby'. Na ur baby be that abi ur papa?
#GodIsWatchingUin3D

E never tey wey u escort ur boyfriend climb bike, u come update 'Drive safely boo'
#GodIsWatchingUin3D

U talk say u just buy ur BB but u go buy the pin later. Ok we dey wait.
#GodIsWatchingUin3D

U say u jst enter Unilag, person ask how ur matric, u come talk say u no too like that course coz the lecturers dey harsh.
#GodIsWatchingUin3D

Na one week u spend for Dubai, u come dey form British accent. Person ask u hope u've not been standing here for long? U com talk 'it have tey' in British accent.
#GodIsWatchingUin3D

Keep it rolling...

1 comment: